15 “ ‘Una must kount seven weeks from di day afta di Sabat Day, wen una bring di first korn wey una harvest kom give God.
Una must keep di Week Feast wen una don bigin harvest di first fruit from una farm and di Tanksgivin Feast wen di year don end.
“ ‘Make una kount seven times seven years and e go bi forty-nine years.
“ ‘For di first day wen una dey do di harvest feast, wen una dey give di ofrin for new korn to God, una go gada woship and una nor go do any work.
Wen Pentekost Day rish, di disciples kon gada for one place.