Levitikus 23:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
13 With di lamb, una go offa two kilogram of flower wey dem mix with olive oil for food ofrin. God like dis ofrin smell. Una go offa am togeda with one lita of wine.
Una go still dey give mi five pound of flower evry morning with one kwota of olive oil wey dem mix with flower. Una must kontinue to give dis ofrin forever.
Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!
“For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom.
“Dis na di ofrin wey Aaron and en sons go present to God for di day wey dem go anoint dem: One kilogram of flower (di same amount as evriday korn ofrin), half for morning and half for evening.