Aaron and en sons must wear am anytime dem enter di tent where dem for dey do meetin or wen dem dey go serve for di Most Holy Place for di altar, so dat dem nor go die, bikos of any sin. Dis kommandment na for Aaron and en shidren-shidren forever.”
“Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.
And una nor go kommit any sin, since na di best part una give. Una must dey kareful, so dat una nor go trit di holy tins wey Israel pipol get, anyhow, bikos if una do am, una go die.’ ”