Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 22:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 E nor go chop any animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, bikos e go make am unklean. Na mi bi di Oga una God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 22:8
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Una go still do like dis for una animals; dem fit dey with dia mama for seven days, but una go give dem to mi for di eight day.


“Una go bi my holy pipol, so make una nor chop any animal wey anoda animal kill for bush. Una must trow di animal meat give dogs.


But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”


Di priests nor go chop bird or animal wey die on dia own or wey anoda animal kill.”


Anybody wey kom from Israel or strenja wey chop animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening.


Una must nor chop animal wey just die on en own or wey wiked animal kill, but una fit use di dead body do anoda tin.


Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ