Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 22:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 Make una nor disgrace my holy name, bikos I go show as I dey holy among Israel pipol. Na mi bi God wey make una dey holy

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 22:32
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.


Make yu remember sey, mi wey bi God wey get pawa, dey holy, so na mi yu must fear.


Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.


“ ‘Make una nor give una pikin as ofrin to Molek juju, bikos e go disgrace Oga God name.


Make una obey my laws, bikos na mi bi God wey make una dey holy.


If not, en shidren wey suppose dey holy go kon dey unklean. Na mi bi God and I don separate am as my High Priest.’ ”


Di pipol must si di priest as pesin wey dey holy, bikos na-im dey give di food ofrin to mi. I dey holy and I dey make my pipol holy.


if anybody wey nor suppose to chop am, chop am, e don bring wahala to ensef. Na mi bi God and I don make di ofrin holy.’ ”


“Make yu tell Aaron and en sons sey make dem nor disgrace my name wey dey holy, but make dem trit di holy ofrin wey Israel pipol offa give mi with respet. Na mi bi God.


Make una try to do all my kommandment. Na mi bi Oga God.


and na mi karry una komot from Egypt, so dat I go bi una God. Na mi bi Oga God.”


“So make una pray like dis: “ ‘Awa Papa wey dey for heaven, wi praiz yor name,


So Jesus tell dem, “Wen una dey pray, make una sey: “ ‘Awa Papa wey dey for heaven, wi greet yu, Make yor kingdom kom.


Make yu protet dem with di trut, bikos na yor word bi di trut.


To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ