Make una obey my laws. Make una nor allow two difren animal sleep togeda. Make una nor plant two difren seed for one whole; or wear klot wey dem use difren material take make.
If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.