Nobody force Israel pipol as dem dey give dia ofrin to God. Evry man and woman bring as en heart move am to bring, so dat dem go take am do all di work wey God kommand dem thru Moses.
Una tink sey e nor dey bad to offa animal wey blind and dey sick as sakrifice to mi? Make una try give dat kind animal to una govnor, weda e go happy or give una anytin wey una ask from am.
But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God.