Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 22:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Una must nor offa anytin wey nor dey okay, bikos I nor go asept am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 22:20
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God wey get pawa sey, “For di first day for di first mont, yu go sakrifice one melu wey dey okay kon klean di temple.


“ ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am.


Make una nor give God any animal wey en private part get sore, kut, get mark or kut komot. Una must nor do dis tins for una land.


Make una nor offa any animal wey una get from strenja as food ofrin to God, bikos dat kind animal nor dey klean and I nor go asept dem.’ ”


“ ‘Wen pesin won give en animal as peace ofrin, e fit bi man or woman own, but di animal must dey okay.


“ ‘Dem fit use sheep or goat take do peace ofrin, weda na man or woman, but e must dey okay.


Una tink sey e nor dey bad to offa animal wey blind and dey sick as sakrifice to mi? Make una try give dat kind animal to una govnor, weda e go happy or give una anytin wey una ask from am.


“Dis na my kommand: ‘Make una tell Israel pipol make dem bring red melu wey dey okay and wey dem neva use take work before.


But una must give burnt ofrin to God; di smell wey God dey like: una go give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.


But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God.


Make una nor sakrifice any animal wey nor well or get problem give di Oga una God, bikos dat kind tin dey make am vex.


wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.


but na with Christ blood and na dis Christ bi God lamb wey nor get any mark or stain.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ