“Make yu tell Aaron and en sons sey make dem nor disgrace my name wey dey holy, but make dem trit di holy ofrin wey Israel pipol offa give mi with respet. Na mi bi God.
“Wen anybody disobey mi by mistake kon kommit sin as e nor obey God holy propaty, den e go bring guilt ofrin to God. Di ofrin must bi en own ram wey dey okay, or e fit use silva take buy betta one, just as dem dey measure am with di Tabanako shekel.
“And dis na yor own: special ofrin wey kom from dia gift, togeda with all di peace ofrin wey Israel pipol give. I don give dem to yu and yor shidren forever. Evribody wey dey klean for yor family, go fit chop am.