20 man wey get hunch-back or man wey bi dwarf; man wey get diziz for eye or for en body and man wey nor gri marry.
Strenjas wey dey follow una woship, make dem nor sey “God nor go ever take us as en pipol.” And man wey nor fit sleep with woman, make e nor sey, “My own don finish for dis life bikos I nor go ever fit born pikin.”
man wey en hand and leg break;
Any animal wey blind, wey nor dey waka, get problem, sore or skin wey dey tear, make una nor offa am give God as ofrin.
Make una nor give God any animal wey en private part get sore, kut, get mark or kut komot. Una must nor do dis tins for una land.
If anybody wound or dem kut en private part komot, make una nor let am kom God present.
Make una nor let pesin wey nor know en papa kom God present; even to en tent generashon, make nor of dem enter where God dey.