Levitikus 21:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
12 E must nor komot from di temple or enter where dead body dey, even if na en papa or mama die, bikos e don dey holy thru God anointin oil. Na mi bi Oga God.
God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.
But una nor go komot from di tent gate or una go die, bikos di anointin oil don make una dey holy for God present.” So dem kon do wetin Moses tell dem.
Moses take some anointin oil and some blood wey dey di altar kon sprinkol dem for Aaron, en sons and for dia garment. Na so e take klean dem and dia klot, so dat dem go dey holy to serve God.
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.