Levitikus 21:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 “ ‘Wen dem don pour di anointin oil for High Priest head, e don dey klean to wear di garment wey priests dey wear and e must nor komb en hair or tear en garment.
David kon go Mount Olives bigin kry. E nor wear any shoe and e kover en head to show how e nor dey happy. All di pipol wey follow am still kover dia head as dem dey kry.
Nor let pipol hear yu kry. Nor skrape yu head or waka with ordinary leg like sey yu dey mourn. Nor kover yor face or chop di kind food wey pipol wey dey mourn dey chop.”
“As for di pesin wey get di diziz, dem must tear e klot; nor komb en hair and e go kover en face dey shaut sey, ‘I nor dey klean! My body dirty well-well!’