Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 20:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make una obey my laws, bikos na mi bi God wey make una dey holy.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 20:8
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Go tell Israel pipol sey, ‘Una must keep my Sabat Day, di day wey I dey rest, bikos na sign between mi and una thru-out una generashon and e dey show sey na mi bi di God wey choose una.


I still give dem my Sabat wey go show my promise with dem, so dat dem go remember sey na mi make dem dey holy.


Wen I don build my temple for dia land forever, den di oda nashons go know sey, mi God don choose Israel as my own pipol.”


Make una obey my laws. Make una nor allow two difren animal sleep togeda. Make una nor plant two difren seed for one whole; or wear klot wey dem use difren material take make.


Make una obey all my laws and kommandment. Na mi bi God.’ ”


Una must dey holy to mi, bikos mi wey bi God dey holy and I don separate una as my own.


Di pipol must si di priest as pesin wey dey holy, bikos na-im dey give di food ofrin to mi. I dey holy and I dey make my pipol holy.


Make una nor disgrace my holy name, bikos I go show as I dey holy among Israel pipol. Na mi bi God wey make una dey holy


Pesin wey do wetin my Papa for heaven wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama.”


Una bi fool wey blind! Wish one big pass, na di gold or di temple wey make di gold holy?


So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom.


“Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.


Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.


Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


Make God wey dey give peace, help una to dey holy go rish di end, so dat for di day wen Christ go kom, una spirit, soul and mind go dey without fault.


But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.


Make una nor dey deceive unasef as una dey hear God word, but make sure sey una dey do wetin en word tok.


God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ