But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”
where dem go for bi strenja. Dat time, dem go remember kon know sey I don ponish and disgrace dem, bikos dia heart rijet mi and dem kon decide to serve juju. Dem go hate demsef, bikos of di bad and wiked tins wey dem don do.
Dem dey ask wood make e show dem wetin go happen for future! Na stik dey tell dem wetin dem won know! Dem don leave mi. Dem bi like ashawo and dem don give diasef to oda gods.
“ ‘If any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land chop meat wey still get blood, God go turn against am and e nor go dey among God pipol again.
“ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”
mi mysef go turn against dat man and en family. I go remove am from my pipol, both en and all di pipol wey follow am woship dat juju wey dem dey koll Molek.
One day, as wi dey go di place where dem for dey pray, one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon, kon si us. Di girl oga dey use am make plenty money, anytime e tell pipol wetin go happen.