Make dem ponish anybody wey nor obey yor God law or di law for di kingdom: dem go kill or porshu di pesin komot from di town. Dem fit seize en propaty or put am for prison.
And dem even build where dem go for dey woship for Tofet wey dey Ben-Hinnom Valley, so dat dem go fit sakrifice dia shidren give juju for der. Dis na wetin I sey make dem nor do! True-true, dat kind tin neva even enter my mind to tell dem.
If una fear God kon serve and obey am and una nor go against wetin E tok and if una and di king wey dey rule una follow di Oga una God, den evritin go dey well with una.