Naw, e get one man from Baal-Shalishah wey bring en first food kon give Elisha. Di bread na twenty. Elisha kon sey, “Make yu gi-am to di pipol make dem chop.”
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen dem enter di land wey I won give dem kon harvest dia korn, make dem take di first ones wey dem harvest go give di priest.
With di lamb, una go offa two kilogram of flower wey dem mix with olive oil for food ofrin. God like dis ofrin smell. Una go offa am togeda with one lita of wine.
God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.
make una put some of di first fruits and plant wey una harvest inside one basket kon bring dem kom di place wey God don choose for woship and where dem go for honor en name.
Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.