13 Make una put salt for all una korn ofrin, bikos di salt dey show di kovenant between una and God.
Una nor know sey di oga wey bi Israel God get agriment with David family sey, dem go rule Israel forever?
7,500 silva pound, 100 bags for wheat, 100 gallon for wine, 100 gallons for olive oil and plenty salt.
Use dem take make incense wey dem mix with perfume. E must dey smooth, pure and holy.
den bring dem kom meet mi. Di priest go pour salt for dia body kon burn dem as ofrin give mi.
All di special ofrin for di tins wey dey holy wey Israel pipol give to God, I don give dem to yu and yor shidren forever. E go bi salt kovenant forever to God and na for yu and yor shidren-shidren.”
“Na una bi salt for dis eart. But if salt nor get taste; how e go bi for pipol mout? E betta make dem trowey am and make pipol mash am.
Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody.