Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 2:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Una go give God ofrin from di first korn wey una harvest each year, but una nor go burn am for di altar.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 2:12
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Abraham kon buy Efron field for Makpelah, wey dey near Mamre, plus di field, di grave and all di land wey dey near am


Wen dem give di orda, Israel pipol bring dia grain, wine, olive oil, honey and all wetin dem get for dia farm. Dem bring one for evry ten tins wey dem get and dem plenty well-well.


“Make una give mi una plant and wine ofrin. “Una must give mi di first son wey una born.


“Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house. “Make una nor kook yong goat wey still dey suck en mama breast.”


Una must keep di Week Feast wen una don bigin harvest di first fruit from una farm and di Tanksgivin Feast wen di year don end.


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen dem enter di land wey I won give dem kon harvest dia korn, make dem take di first ones wey dem harvest go give di priest.


Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest.


E go still give bread wey dem bake with yist for dis ofrin too.


Una go give kake from una first flower wey una grind as special ofrin, just as una do for di first korn wey una grind.


“I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God.


But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too.


And naw, awa God, wi don bring di first fruit, plants and animal wey Yu give us for dis groun.” Make una put evritin for di Oga una God present, den bow woship am.


Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ