35 Make una nor play wayo wen una dey measure how sometin long and wide rish or oda tins wey many.
Na dem still dey kare for di bread wey dey der; di ofrin flour; di bread wey nor get yist; to dey mix dem and all di tins wey dem dey measure.
God hate pipol wey dey play wayo, but E dey love doz wey dey do good tins.
Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol, bikos God nor like am.
God hate pipol wey dey weigh and measure tins with wayo.
Evribody must measure well So from naw go, make evribody dey measure well.
“ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.
Make una listin to wetin God dey tok: “Make una stand up kon tok wetin I do una. Make di mountins and hills bi witness to wetin una dey tok.
Bikos as una dey judge, na so God go take judge una. And as una dey do to oda pipol, na so dem go do una too.
Wen una dey measure tins, una must measure well
Make una always dey use di rite skale take measure, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una.