Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 19:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 Make una nor ponish strenjas wey dey stay for una land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 19:33
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.


“Make una nor sofa or opress strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.


“Make una nor sofa or opress strenjas wey dey stay with una. Unasef know wetin e mean to bi strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.


Make una stop to opress di strenjas among una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die. Make una stop to kill innocent pipol and woship oda gods, bikos e go distroy una.


Doz wey get money dey shit and tif from oda pipol. Dem dey ponish poor pipol and dey kollect strenjas propaty.


Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


Make una nor opress poor pipol and doz wey dey work for una; weda dem bi Israel pipol or strenjas wey dey stay with una.


Una must judge well for di strenjas wey dey with una; doz wey nor get papa and mama and woman wey en husband don die. Make una nor ever take dia klot as shorti for debt.


Make una always remember sey una bi slave for Egypt, before di Oga una God kon save una. Na dis make mi give una dis kommand.


Strenjas, pesin wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die, if anybody nor judge dia kase well, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ