Batsheba go meet di king, make e for tell am wetin Adonijah tok. Di king stand up, bow greet en mama, den e sidan for en throne kon bring anoda chair for en mama make e for sidan for en rite side.
Dem go dey fight each oda; Men go oppoz each oda and neighbours go fight against dia neighbour. Yong pipol nor go respet dia senior and foolish pipol go dey curse doz wey dem bin dey respet.”
Make yu nor tok anyhow to pesin wey old pass yu, but dey tok to am with respet like sey yu dey tok to yor papa. Tok to yong men as yu go take tok to yor broda.