Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 19:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Make una nor go take advise from pipol wey dey serve dead pipol spirit. If una do am, una go dey unklean. Na mi bi Oga una God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 19:31
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem offa dia shidren as sakrifice and dey do majik and oda bad-bad tins. Dem decide to dey do bad tins for God present and na dis make God dey vex.


E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.


King Josaya still distroy all di pit from where dem for dey koll evil spirit kom out. Di pipol wey dey do majik; dia juju for house; di yeye image and all di juju wey dey for Judah and Jerusalem land, e distroy dem too. Like dis, e kon do all di tins wey dem rite for di book wey Priest Hilkaya si for di temple.


Saul die bikos e nor respet or obey God kommand. E go meet spirit make e help am


E sakrifice en sons for fire for Ben-Hinnom Valley kon dey do juju and many bad-bad tins. E dig one pit and for der, doz wey don die, dem dey koll dia spirit kom back to life. E put majishan make dem dey supavise am. E do many wiked and bad tins wey make God vex.


Jerusalem go fall and as dem dey groun dem go kry for help, but nobody go hear dia vois.


Even all di many advise wey dem advise yu don make yu weak well-well. Yor pipol wey dey read di star and doz wey dey tok as weda go bi, make dem kom out kon save yu from wetin go soon happen to yu.


But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”


“ ‘Una must nor chop anytin wey still get blood for inside. Una must nor do majik or serve juju.


Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.


“ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”


Dem dey listin to am bikos, e don tey wen e dey use majik take dey do wonders.


to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol;


But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”


Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ