Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 19:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 or draw picture for body; or kut mark to mourn pesin wey die. Na mi bi God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 19:28
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So dem shaut well-well, just as dem always dey do for dia juju. Dem use spear and swod dey kut demsef, until blood bigin komot from dia body.


Rish and poor pipol go die for dis land and nobody go beri or mourn for dem. Pipol nor go kut dia body or shave dia hair to show sey dem dey mourn for dem.


All of dem don shave dia hair and barber dia bear-bear. Dem wear sak kon kut dia hand, so dat di marks go show sey dem dey mourn.


Una must nor kut di hair wey kover una head or barb una bear-bear,


Make una nor disgrace una girl pikin kon make am bi like ashawo; if una do like dat, di land go turn where ashawo and wiked pipol full.


God tell Moses: “Make yu tell di priest wey bi Aaron sons sey, ‘For pesin wey don die, make any priest nor go dirty ensef bikos e go di burial.


E must nor go where dead body dey; e must nor make ensef unklean even for en papa or mama.


Make di priest nor barb any part for en head, shave en bear-bear or kut en body.


Evriday and nite for di beri groun near where mountin dey, e dey shaut, dey use stone dey kut en body.


Di oda disciples kon tell am, “Wi don si Jesus.” But e ansa dem, “Unless I si en two hand wey dem nail kon put my finger inside di whole wey di nail make and shuk my hand inside di whole wey dey en belle, I nor go ever bilive una.”


Since una bi Oga God shidren, make una nor ever kut unasef or shave una hair sey una dey kry for who don die.


Di smoke from dis sofa go dey go up forever and ever. Doz wey dey woship di beast, en image and doz wey kollect di mark, nor go rest for day or nite.”


Di third angel kon follow di first two, dey shaut: “If anybody woship di beast and en image kon kollect di mark for en fore head or hand,


I kon si anoda tin wey bi like river wey dem mix with fire and I still si di pipol wey konker di beast, en image and di nomba for en name. Dem stand near di river kon whole harp wey God give dem.


So di first angel pour wetin dey en basin put for di eart. Den di pipol wey get di beast mark and doz wey dey woship en image kon get sore wey dey pain well-well for dia body.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


Den I si thrones and pipol wey God don give authority to judge, sidan on-top di thrones. Doz wey dem kut dia head komot bikos of di trut about Christ and God word, I still si dem too. Dis ones nor woship di beast or en image and dem nor gri make dem put en mark for dia fore head or hand. Dis pipol raiz-up kom life kon rule with Christ for 1,000 years.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ