24 For di fourt year, all en fruit go dey holy and e go bi praiz ofrin to God.
Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.
“ ‘Wen una enter di land kon plant tree for food, make una nor chop di first fruit wey e go bear. Make una nor chop am for di first three years.
Den for di fift year, una fit chop di fruit wey e bear kon add am join una harvest. Na mi bi di Oga una God.
Di first share for una harvest, new wine, olive oil and di wool wey una kollect wen una dey shear di sheep, make una give dem to di priest.