Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 19:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 19:16
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pesin wey sell en friend bikos of money, na en shidren go sofa am.


I go distroy anybody wey dey plan bad for en neighbour and I nor go sorry for who dey deceive pipol or doz wey get pride.


Doz wey nor dey judge odas, wound dia neighbours or tok bad about dia friends.


Una go just sidan dey tok bad about una broda; di pikin wey una own mama born.


“Make una nor dey tok wetin una eye nor si. Make una nor join wiked pipol lie for pesin head.


“Make una nor akuiz pesin for wetin e nor do and make una nor kill good pesin, bikos I nor go free anybody wey do like dat.


Anybody wey pritend sey e like pesin, dey lie and anybody wey dey lie waka, na fool.


Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret, but yu fit trust pesin wey dey tok trut.


Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret. So make yu run from pesin wey dey tok too mush.


I ansa, “Dem bi sturbon and wiked pipol; dia heart strong like bronze and iron. Dem dey lie waka and na so-so bad-bad tins dem dey do.”


Make evribody dey kareful of en friends and make yu nor trust yor broda, bikos even broda dey shit en broda. And friends dey lie against each oda well-well.


Some of una dey lie for pipol head, so dat dem go kill dem. Some dey chop food wey dem don sakrifice give juju and some like ashawo life.


kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!” But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”


Anybody wey kollect money to kill pesin wey nor do anytin, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


Like dis too, dia wifes must get good karata, nor bi wifes wey dey lie or gossip, but dem must fit dey kontrol diasef and dey honest for evritin.


Dem nor get love or forgivenes; dem go dey gossip odas and nor fit kontrol diasef. Dem go dey wiked and hate wetin good.


Make yu tish old wimen sey, make dem live life wey go make God happy. Make dem nor tok bad about pipol; nor dey drink anyhow, instead make dem tish oda wimen wetin dey good.


Make una stop to do bad tin; dey deceive pipol, pritend; dey jealous and tok bad about pipol.


Yu yorsef go know sey today God don put yu for my hand for inside di rock. Some of my men sey make I kill yu, but I sorry for yu kon sey, ‘I nor go do bad tin to my oga, bikos na God choose am.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ