Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 18:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 bikos di pipol wey dey di land before, don do all dis evil tins and di land don dey unklean.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 18:27
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di one wey bad pass bi sey, e get some wimen wey dey do ashawo work for doz place wey dem for dey serve juju. Judah pipol do tins wey dey make pesin shame, just as di pipol wey God drive komot for di land before, dey do.


E dey do like odas wey rule Israel before am. E even burn en pikin as ofrin and dis na one bad sin wey di kountries wey God porshu komot for der, dey do.


E nor gri obey God and e kon dey sin like di oda kountries wey God drive komot der.


All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.


Dem proud and sturbon kon dey do tins wey I nor like and na dis make mi distroy dem, just as all of yu know.


Some dey sleep with pipol wife or husband and odas dey sleep with dia pikin wife or dia half sistas.


God sey, “Wen I first si Israel, e bi like wen yu si grape wey dey grow for desert. Wen I first si una grand-grand papa dem, e bi like wen yu first si ripe fig for en sizin. But dem go meet Baal for Peor kon dey woship am and dem kon bi like di juju wey dem love.


“ ‘Make una nor spoil unasef with dis tins, bikos di pipol wey I dey drive komot for una, don spoil demsef with all dis tins.


Una must obey all my law and kommand and una nor go do dis evil tins, both Israel pipol and doz wey bi strenjas,


Make una nor make di land rijet una, bikos una spoil am, just as e rijet di pipol wey dey der before.


If una distroy dem finish, di pipol for di land nor go dey to tish una how to serve and woship dia own gods and juju wey go make una sin against di Oga una God.


Wen una dey bring una vow ofrin, make una nor bring any ashawo pesin ofrin kon give di Oga una God, weda na man or woman, bikos dat kind tin dey make di Oga una God vex.


Doz wey dey measure with fake skale, dey sin against di Oga una God.


‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ