But Leah ansa, “So my husband wey yu take neva do yu? Yu won still take my pikin mandrake too?” Rashel ansa, “Okay, make yu give mi some mandrake and e go sleep with yu dis nite.”
“ ‘Make una nor sleep with both mama and dota. And make una nor sleep with di woman grand-pikin, weda na en son or dota born am. Dem bi klose family and dis tin dey wiked well-well.
God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.