Levitikus 16:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
4 Before Aaron go enter di place wey holy pass, e must baf and wear di garment wey priests dey wear; wey bi linen robe and short nika, both di belt and di priest kap.
Before dem go-go di kourt for outside where pipol dey, dem go first pul dia klot wey dem wear take work inside di temple kon leave am for di holy rooms. Dem go wear anoda klot, so dat dia holy klot nor go tosh pipol.
At wons, six men just kom out from di nort gate for di temple, each of dem karry swod. E get one man among dem wey wear linen and e whole sometin for hand wey e won take rite. All of dem kon stand near di bronze altar.
Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven