33 kon santify di place wey holy well-well, where dem for dey do meetin, di altar, di priests and all di pipol for Israel.
God wey get pawa sey, “For di first day for di first mont, yu go sakrifice one melu wey dey okay kon klean di temple.
“Wen Aaron sakrifice di melu as sin ofrin for ensef and en family,
Na like so e go take do sakrifice for di Holy Place for Israel pipol sin. E go still do sakrifice for di tent, bikos di tent dey centre for di kamp even as dem nor dey holy.
E must baf for di holy place kon wear en own klot. Afta dat, e go komot go give di burnt ofrin for en and di pipol sin.
“E go give one melu as sakrifice make God for forgive en and en family dia sins.
Una nor go do any work for dat day, bikos na di day to pray make di Oga una God forgive una.