Wons evry year, Aaron go klean di altar with blood from di horn and dem go dey do like dis from one generashon go rish anoda, bikos e dey holy to Oga God.”
Yu go take some of en blood kon put am for di four horn, di korna for di altar, di one for middle and round di korna dem. Like dis, yu go klean di altar kon make am dey holy.
“Di next day, yu go take one man goat wey dey okay kon offa am as sakrifice for sin. Yu go use en blood take klean di altar, just as yu do with di melu own.
Na like so e go take do sakrifice for di Holy Place for Israel pipol sin. E go still do sakrifice for di tent, bikos di tent dey centre for di kamp even as dem nor dey holy.
From di time wey Aaron enter di place wey holy well-well go do di sakrifice, go rish wen e go kom out, nobody must dey inside di tent. Wen e don do sakrifice for ensef, en family and di whole kommunity,
Den e go put some blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain for under di altar wey dem dey use take dey burnt sakrifice wey dey di tent gate.
Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar.
Den e go put some of di blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain under di altar wey dem dey use take dey burn ofrin, wey dey di tent gate.
True-true, Jesus make pipol dey holy, so en and di pipol wey e make holy, na God kreate dem. Na dis make am nor dey shame to koll dem en brodas and sistas.