22 Anybody wey tosh di chair wey e sidan put must go wosh e klot, baf with wota and e go dey unklean till evening.
“ ‘Anybody wey tosh unklean animal dead body don spoil ensef and dat pesin go dey unklean till evening.
Anybody wey tosh di bed wey e sleep put must wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening.
If anytin dey for di bed or di chair wey e sidan put, wen e tosh am e go dey unklean till evening.
Anytin wey unklean pesin tosh, go dey unklean and any oda pesin wey go tosh am go dey unklean till evening too.’ ”