Nobody from Aaron family wey get diziz or dey discharge go chop di holy ofrin until e don dey holy. Pesin wey tosh anytin wey nor klean, bikos di tin tosh pesin wey don die; man wey dey discharge;
So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.
But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.