11 Anybody wey tosh di man wey discharge and e nor wosh en hand, must go wosh en klot and baf with wota, but e go still dey unklean till evening.
“ ‘Anybody wey tosh unklean animal dead body don spoil ensef and dat pesin go dey unklean till evening.
Anybody wey tosh wetin e sidan put go dey unklean till evening. Anybody wey karry wetin di pesin sidan put must go wosh en klot, baf, but e go still dey unklean till evening.
If di man tosh klay pot, dem must break am and if na plate wey dem make with wood naim di man tosh, dem must wosh am.
Anytin wey unklean pesin tosh, go dey unklean and any oda pesin wey go tosh am go dey unklean till evening too.’ ”
Wen evening don rish, make e wosh ensef with wota, den wen sun don go down, e fit enter di kamp again.