52 Like dis, e go santify di house from di diziz with di bird blood; di klean wota; di bird wey dey alive, di cedar wood, di hyssop leaf and di red rope.
di priest go orda sey make dem bring two klean bird, part for cedar wood, red rope and some hyssop leaf.
E go take di cedar wood, di red rope, di hyssop leaf and di bird wey dey alive, deep dem inside di blood kon sprinkol am for di house seven times.
E go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field. Na like dis di priest go take santify di house and e go dey klean.