E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”
Jesus kon tell dem, “Una dey si all dis tins? I tell una true word, wen di time rish, one block nor go dey on-top anoda one, bikos di building go skata finish!”