“If di pesin dey poor and e nor get money, e go bring only one special man lamb as en ofrin to God and na di priest get am. E go bring one kilogram of flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and three lita of olive oil.
“ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.