Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 14:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 “If di pesin dey poor and e nor get money, e go bring only one special man lamb as en ofrin to God and na di priest get am. E go bring one kilogram of flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and three lita of olive oil.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 14:21
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.


If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem, so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am.


Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.


For one melu and ram, e go take half-half bag of korn follow body as ofrin and for di sheep, di ofrin go bi anytin wey e like to offa. For evry half bag of korn ofrin, e go karry three kwota of olive oil follow body.


“ ‘If di man one give bird as burnt ofrin, e must bi dove or pijin.


“ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”


“For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom.


E go still bring two dove or two pijin, one for di sin ofrin and one for di burnt ofrin.


If e nor get money take pay en vow, e must take di pesin to di priest and di priest go reduce di money, akordin to wetin di pesin go fit pay.


“ ‘But if di man nor fit bring two dove or pijin, e go bring one kilogram for flower as di sin ofrin. E nor go put any olive oil or incense join am, bikos na sin ofrin e bi, nor bi korn ofrin.


“ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.


Den Jesus look en disciples, tell dem, “Make una happy, una wey dey poor, bikos na una get God Kingdom.


Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.


Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.


E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ