Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 13:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Di priest go look am again for di sevent day and if di sore don dey go, e go kon sey e dey klean; bikos na only sore e get. Di pesin go wosh en klot and e go dey klean.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 13:6
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

make Yu listin to dia prayers and if anybody wey dey face pain for Israel, stresh en hand pray for dis temple,


make Yu listin to dia prayer. Make Yu hear dem from heaven kon give dem viktory.


So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.


E get anybody wey fit sey en mind klean well-well and e nor dey sin?


bikos e nor get anybody for dis world wey dey good well-well and nor dey sin.


E nor go break di wood wey bend or lite lantan wey nor good. En good judgement go dey di whole world forever.


Anybody wey karry dia dead body, go-go wosh en klot and e go dey unklean till evening.


and di pesin wey karry dia body, go-go wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis animals nor dey good for una.


If anybody chop any part for di animal, e must wosh en klot, but e nor go still dey klean till evening. Anybody wey karry di dead body must wosh en klot, but e go dey unklean till evening.


“If anybody get sore, boil or spot and e turn to diziz for en skin, dem must karry am go meet Aaron wey bi di priest or en sons.


Di priest go look am again for di sevent day and if e feel sey di sore still bi as e bi before, e go separate am for anoda seven days.


But if di sore spread afta di priest don look am sey e klean, e must go meet di priest again.


“Di pesin go wosh e klot, barber en hair kon baf; den e go dey klean. E go fit enter di kamp, but e go stay outside en house for seven days.


Make una dey welkom God pipol. Even doh dia faith nor too strong, make una nor curse dem, bikos of wetin dem dey tink sey dey good or bad.


So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.


En pipol nor dey respet or fear am; dem nor dey bihave like en shidren and na dis bi dia sins. Dem wiked well-well and na lie-lie full dia generashon.


So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.


To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.


bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ