5 Di priest go look am again for di sevent day and if e feel sey di sore still bi as e bi before, e go separate am for anoda seven days.
Anybody wey go take-ova from Aaron as priest among en sons, go wear di garment for seven days as e dey serve for di Tabanako and di Holy Place.
“But if di sore dey white and e nor deep pass di skin and di hair neva shange to white, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days.
Di priest go look am again for di sevent day and if di sore don dey go, e go kon sey e dey klean; bikos na only sore e get. Di pesin go wosh en klot and e go dey klean.
“Di pesin go wosh e klot, barber en hair kon baf; den e go dey klean. E go fit enter di kamp, but e go stay outside en house for seven days.