43 Di priest go look am, if di diziz na di one wey dey red and white for di back or for di front where hair nor dey,
But I go ponish dem, I go kut dia hair kon shave dia head to bololo.”
Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again.
Yu go separate wetin bi God own from human being own; wetin holy from wetin nor dey holy.
den di boil kon swell-up and white or red-white spot kon appear for where di boil dey before, e go-go meet di priest.
But if rashes wey dey red dey for di back or di front wey hair nor dey, den dat na diziz.
den di man don get strong diziz bi dat. E nor dey klean. Di priest must sey di man nor dey klean, bikos of di diziz wey dey en back head.