From Jeriko, Elisha kon go Bethel. As e dey waka for di street, some small-small boys kom outside from di town kon dey curse am dey sey, “Bololo head! Bololo head!”
Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.
“I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.
(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.