But if di hair for where di spot dey turn white and e nor deep pass di skin wey dey near am, but e get lite kolour, di priest go separate am from oda pipol for seven days.
But if di spot nor shange, spread and e get lite kolour, den nor bi skin diziz. Di priest go sey e dey klean, bikos na just mark from di fire wey burn am.