Levitikus 12:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
8 “ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”
“If di pesin dey poor and e nor get money, e go bring only one special man lamb as en ofrin to God and na di priest get am. E go bring one kilogram of flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and three lita of olive oil.
E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.
“ ‘But if di man nor fit bring two dove or pijin, e go bring one kilogram for flower as di sin ofrin. E nor go put any olive oil or incense join am, bikos na sin ofrin e bi, nor bi korn ofrin.
“ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.
Den Jesus enter di temple aria kon drive all di pipol wey dey buy and sell inside di temple, e skata di tabol and chair wey di pipol dey take shange money and sell dove.