Bikos of di blood wey e lost, di woman go stay for thirty-three days, before e go dey klean. E must nor tosh anytin wey dey holy and e nor go enter di Tabanako, until di day wey dem go santify am, don komplete.
“ ‘Wen dem don santify am finish, weda na boy or girl e born, e go-go di tent wey dem for dey meet go give di priest one lamb wey bi one year for burnt ofrin and one pijin or dove for sin ofrin.