All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.
“ ‘Or if yu tosh anytin wey nor dey klean and yu nor know; sometin like dirty animal wey don die. Wen yu kon know wetin yu do, yu must show sey yu nor dey klean again and yu don sin.
E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.
‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”
To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.