Levitikus 11:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
47 And dis law na to separate between wetin dey klean and wetin nor dey klean, so dat pipol go know di animals wey dem suppose chop and di ones wey dem nor go chop.’ ”
Yu must karry seven man and seven woman for evry klean animal follow body, but for evry animal wey nor dey klean, yu go take only one man and one woman.
Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again.
But Daniel kon decide sey e nor go chop di sweet food and wine wey dem dey serve for di king palis, bikos e nor won dey unklean. So e beg di pesin wey dey lead dem sey, en nor won chop di royal food or drink di wine.