Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 11:40 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

40 If anybody chop any part for di animal, e must wosh en klot, but e nor go still dey klean till evening. Anybody wey karry di dead body must wosh en klot, but e go dey unklean till evening.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 11:40
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Una go bi my holy pipol, so make una nor chop any animal wey anoda animal kill for bush. Una must trow di animal meat give dogs.


Make una go wosh unasef klean and stop all di evil tins wey una dey do.


I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.


But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”


Di priests nor go chop bird or animal wey die on dia own or wey anoda animal kill.”


Anybody wey karry dia dead body, go-go wosh en klot and e go dey unklean till evening.


and di pesin wey karry dia body, go-go wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis animals nor dey good for una.


“ ‘If any animal wey yu suppose chop die on en own, anybody wey tosh en dead body go dey unklean till evening.


Anybody wey enter di house for di time wey dem lock am go dey unklean till evening.


Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin. Na like dis di priest go take make sakrifice for di man for God eye.


Anybody wey tosh dem, dey unklean and e must go wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening.


“Di man wey drive di goat go Azazel for di wildaness, must wosh en klot and baf, before e go kom back to di kamp.


Di pesin wey burn dem go wosh en klot kon baf before e go-go back to di kamp.


go dey unklean till evening. E nor go fit chop anytin among di holy ofrin, escept e first go baf.


E nor go chop any animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, bikos e go make am unklean. Na mi bi di Oga una God.


God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.


For di third and sevent day, di pesin wey dey klean go sprinkol di wota for di unklean pesin body. For di sevent day, e go santify di man den di man go wosh en klot kon baf, den e go dey klean for evening.


Yu nor fit drink from God cup and demon cup for di same time.


Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.


Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ