34 If di wota from di pot tosh any food wey una suppose chop or wota wey una won drink, den evritin don dey unklean.
God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.
Na pride dey kontrol wiked pipol and anytin wey kom out from dem, na sin e bi.
If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.
“ ‘And if dia body fall inside pot wey bi klay, evritin wey dey inside di pot go dey unklean and una must break di pot.
Anytin wey dia dead body fall put go dey unklean. Weda na stove or oven, dem go break am to pieces.
Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. But nor-tin dey pure to doz wey bad tins full dia mind.