Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 10:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 “Why una nor chop di sin ofrin for where dey holy? Na bikos e dey holy well-well naim make God give una make E for forgive di kommunity dia sins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 10:17
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Aaron go always wear am for en fore head, so dat e go asept any sin wey Israel pipol kommit as dem dey offa dia gift give mi and den, I go forgive dem.


Aaron and en sons must wear am anytime dem enter di tent where dem for dey do meetin or wen dem dey go serve for di Most Holy Place for di altar, so dat dem nor go die, bikos of any sin. Dis kommandment na for Aaron and en shidren-shidren forever.”


Di goat go karry all dia sin go anoda land wey pipol nor dey.


Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own,


if anybody wey nor suppose to chop am, chop am, e don bring wahala to ensef. Na mi bi God and I don make di ofrin holy.’ ”


God tell Aaron, “Yu, yor sons and yor tribe must sofa for di Tabanako sin; but only yu and yor sons go sofa for di priest sins.


Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.


E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ