Di man kon tell mi, “Dis two buildings wey face di open space so, dey holy. Na for inside dem, di priest wey dey enter God present, for dey chop di ofrin wey holy pass. Bikos di rooms dey holy, di priests go put di ofrin wey holy pass for der: di korn wey dem sakrifice for sin or for ofrin.
Moses kon tell Aaron and en two sons Eleazar and Itama sey, “Make una use di korn ofrin wey remain from di food wey dem offa give God, take make bread wey nor get yist, den chop am for di altar side, bikos na holy ofrin.
Yu and yor family go fit chop di breast and di leg wey dem give as special gift and di special kontribushon wey dem give God. Yu go fit chop am for any place wey dey holy. Na yu and yor sons get dis ofrin, bikos na part of di peace ofrin wey Israel pipol give.